
- Na person wey never see problem dey use English dey pray.
- Book wey no gree enter head go enta exam hall
- Goat wen get mind follow lion go catch fish, make e know say weda dem catch fish or not, Lion food don set oh.
- Who naked no dey chuck hand for pocket…!
- Wetin concern dog wit family planning?..
- Na determination dey make Okada overtake trailer for road.
- This one good, this one good na em mad man take dey gather plenty load.
- Pikin wey go strong go strong…. No be say until dem name am Samson.
- Na over confidence make February no complete.
- Do you know who I am? Do you know who I am?..Naso hold up take dey start.
- Head wey no wan think go carry load..
- Hand wey stay long for pocket, know say nothing de that pocket.
- Forget Trust If trust dey, Water nor for boil Fish.
- No matter how lizard do press-up reach, e no fit get muscle pass crocodile .
- E de clear pimple, e de clear pimple na so bleaching de start.
- Feel at home, feel at home na eim dae make visitor spoil remote
- Escort me, escort me naso slave trade take start.
- It’s a small world!! No mean say you fit trek from Naija go London.
- Christianity is free, but you must buy Bible
- Person nor dey use shame chop winch o
- Make I chop this guy money, Make I Chop this guy money. Na so ashawo take start oh.
- You no need spoon and cutlery to chop slap.
- Jollof Rice wey dey for bottom of pot 2day go dey for top of cooler 2moro.
- The patient dog … Nah hungry go kill am.
- Na I go do am later na e make fowl no fly like other birds.
- No food for lazy man no be for pesin wey em mama get restaurants.
- Who dey hold landlord rentage no dey fry stew way curry dey.
- I am covered by the blood of JESUS E no mean say make u no lock door sleep oooh
- Pastor wey dey pray for mad person no dey Close eye.
- I need pikin, I nepost ikin, na e make woman no wear pant sleep.


